My name na Segun, people dey call me Sege, and na agbero
work I dey do. For this my work ehn, e no get anything wey my eyes no dey see.
I go just dey garage dey hustle jeje, na so I go dey see orisirisi things.
I don see person wey dey wear shirt, trouser and suit
on top conductor work; I don see paraga seller wey dey drive C Class, I don
even see person wey come chop for buka, carry him own woman come o, but when e see
another fine yellow sisi, e leave him woman go follow that one, still no gree
pay for the first woman food.
But as I don see things with this my eyes reach, the
one wey surprise me pass na the one wey I see yesterday o. Omo, I melt o.
As I dey shadow my money for conductor and driver dem
hand, I see one Toyota Camry drive enter. I look am, dey wonder “Who be this
one.” Na him one man and one babe come down. Omo, the babe set no be small;
black beauty, tall, be like angel. I hail the guy for my mind, “Correct bobo wey dey carry fresh fish!
Twale!!”
I look as dem dey waka dey go, I come dey wish say na
me be the guy, make I get correct fine mama like that wey go dey warm my blood.
When dem don go finish, I continue to dey do my work. E no too tey the bobo come
back, come tanda for the car, dey wait the babe.
Small time reach, I look my phone see say my battery
don low, na him I say make I go our oga for garage office go charge am, as Gen
dey always dey on there. As I rush enter like this, wetin I see? Oga and the
babe wey him bobo just drop dey kerewa ni sha! The babe bend, hold table, oga
dey fire am from back. Omo!
Because dem face the other side, dem no see say
person open door. The noise wey the two of dem dey make sef no fit let dem
hear. Na him I jejely and silently close the door back, run comot o.
The thing shake me! I come dey reason the matter with
myself as I dey waka go back my post. “Na wa o, na woman go spoil this world.
Imagine woman wey get this kind correct, clean man, still dey sleep with agbero
oga for garage. Only God know the kind lie she give the man say she wan do for
garage. See the bobo come dey here dey stand like security man, no know say dem
dey fire him wife kpaka kpaka inside office.”
E pepper my body well well, sotay I come decide say I
go tell the man. I no like cheating and this one na big cheating. I no even
send say my oga dey involved, last last I go deny say no be me talk.
Na so I vex go meet the man. But first I say make I clear
my doubt. I ask am, “Bros no vex o, that aunty wey you bring come na your wife?”
The bobo look me up and down, dey wonder say who be
this one wey dey ask jamb question. E sha answer, “She’s my girlfriend. Why you
dey ask?”
“Eh-hen, I talk am. Because I see the way wey una too
dey do when you drop am, I no say una dey marry each other. No spoil body too
much for this thing wey I wan talk o… your wife and our garage chairman dey knack
demselves o, as I dey tell you so dem dey do am for…”
The guy hiss. “Ogbeni wetin concern you? Na everything
you see your mouth go talk?” Na so e waka commot for my side enter car.
Omo I shock o, I melt o. Eeeeeeh! So this guy know
wetin dey happen. E go even be say na him arrange the girl for chairman sef. E
own girlfriend! “Sege, wetin your eyes no go see for this garage work wey you
dey do!”
I carry myself commot, go continue my hustle. E no
too tey, the babe come back. The two of dem hug theirself enter car, drive
comot. See life!
Omo, hustle o, make you no use your own hand dey carry
your girlfriend give agbero oga because of money.
Copyright, Sabigirl.com.
All Rights Reserved!
Enjoyed this story? Your friends will too, share with them:
More frequently than not, however, these presents can be found for restricted occasions only. You can sometimes find presents like these on your chosen operator’s promotions page. While software-specific 바카라 사이트 bonuses are certainly uncommon, they may crop up from time to time.
ReplyDelete